Anambra election results live: Charles Soludo, APGA candidate don win ten local governments so far

Anambra election results live: Charles Soludo, APGA candidate don win ten local governments so far
Collage of some of di candidates
Collage of some of di candidates

Di Independent National Electoral Commission don dey announce di result of di just concluded govnorship election for Anambra state.

INEC dey announce di result local goment by local goment.


Di collation and announcement of di results of di Saturday governorship election start for INEC headquarters for Awka around 11:30 am on Sunday 7 November, 2021.

Di Independent National Electoral Commission, INEC na di umpire for di process and na dem go declare di winner.

According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.

Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).

Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.

Indispensable _Hurly